How shutdown by Bureau de Change go take affect naira to dollar exchange rate
How shutdown by Bureau de Change go take affect naira to dollar exchange rate
Di naira fall to im lowest in history against di dollar as e exchange for over N1,500 for 1 dollar on January 31, 2024
Bureau de change operators for Nigeria capital, Abuja, don shutdown business starting from Thursday. Dia counterparts for Kano, Nigeria second largest city, go also lock shop by 12 noon.
Dis dey come as di naira record im lowest fall against di US dollar, as e dey currently exchange above N1500 to one dollar.
Mohammed Mustapha, di assistant provost marshal of di bureau de change union for Abuja tell BBC Pidgin say di decision na sake of say dem no happy as naira dey tumble against di dollar everiday.
Remember say for 2021, di Central Bank of Nigeria led by Godwin Emefiele, bin ban selling of forex to BDCs sake of say e don become channel to dey do mago-mago. But e later lift di ban in August 2023.
Dis plaza for Wuse Zone 4 area for Abuja, wia many BDC operators get office
Mustapha said the BDC association dey vex say goment and Nigeria pipo dey look dem bad eye, dey point dem bad finger over di foreign exchange wahala for the country
Comments
Post a Comment